30 May 2007

Ope O!

MG don born o, abegi helep me rejoice!

Person go think say na me pregnat de girl as I just dey show my teeth like Cheshire cat since I hear de good news. Gudugbe na 'abi girl' o, I hear say de picken big (4.1kg) and say she long. I happy no be small o, I am anxiously awaiting pictures, I don dispatch everybody wey I know make dem go take picture email to me. I happy sotay, I dey suspect say I no dey coherent. My heart just de do somersault for inside my chest. God is good o! I have been bombarding poor MG (to be known as Maa! from now on) with silly txt messages, I figure they will be less stressful on her as opposed to me calling every 10 mins. I am so happy I could scream (come o wetin dey stop me?) Yippee!!!!!!!!!!!!!!!

1 comment:

Anonymous said...

Who is MG? Anyway I help you to rejoice sha, whoever she is...

Modupe